NA WHO DEY DO YOU?

PEN PIDGIN CORNER

BY PROMISE EZE 200 LEVEL EDU/ECONS

NA WHO DEY DO YOU?




No be small matter. You dey claim say you be student but no know di difference between handout and lecture note because you no dey attend class.

Shey you talk say na night class you dey go. Hmmm. Make I no chook mouth too much but di last time wey you say you dey go do boko na for morocco ground we find you. Na wa ooo.

Assignment nko? You no dey do dat one.

How you wan take pass for inside dis Udus if you no take your studies very seriously? No, tell me. I wan hear your answer. Talk na!

Di last time wey you get carry over, you dey disturb us say na devil dey do you, your village pipo dey pursue you, di lecturer no like you. But if you look well you go realise say na you carry your hand destroy yourself.

Na who do you dis kind thing? Your mates dey hustle to see say dem finish well but di last time wey you enter library na when you wan check if WIFI dey work for there.

Tutorials nko? We find you there but na your absence we jam. You dey school but you no dey school because you no dey do wetin you carry come school.

If you no work hard, no disturb us when result comot ooo. Just keep quiet because na you dey do yourself by yourself. No be lecturer dey do you. No be devil. No be Udus. Na your lack of diligence and focus dey carry your CGPA enter gutter every semester.

Avoid distractions and everything go stew on exam day.

Post a Comment

0 Comments