STUDENTS' UNION PIPO MAKE UNA HELP US OOO!

PEN PIDGIN TORI

STUDENTS' UNION PIPO MAKE UNA HELP US OOO!

BY PROMISE EZE, 200 LEVEL




Student union I greet una. Hmmm, but e like say una don forget us. Ok, una no forget us, but una forget wetin una suppose do for us.

Di matter wey dey bamboozle we student plenty but na small i go write here.


'NO BUlB FOR A—CLASSES'

As I dey write so, plenty class for A class dey swim inside darkness. No be say Nepa no dey give light. Na say di electric bulbs no dey work for dere.

No tell me say una no know say students dey use those classes read for night. No even talk say una no get money to buy bulb for us. Shebi na una carry ambulance come for us abi? E no go bad if una repeat dis kind philanthropy for us na.


'ZURU WALK WAY DEY SLEEP INSIDE DARKNESS'

Sometimes I wonder if these student Union pipo dey live for hostel. If na true say una dey hostel, una must sabi say zuru walk way need light for there. Many student don wound for there because dem no dey see where dere leg dey enter. Una carry money build walkway but una forget to put light dere. How una think am na? E Fair?

"JATTO WALKWAY NEED BETTER LIGHT"

I no wan talk too much for here. I believe say una sabi di matter pass me. Make una help us by putting light dere. However, I thank una for di one wey una don do.


"UNA NEED TO CHOOK EYE INSIDE THE AFFAIRS OF STUDENT WEY DEY LIVE FOR VILLAGE"

I never see when una dey put students wey dey live inside village into una yearly plans and consideration. E get plenty things way dem dey pass through. One of dem na di lack of water way dem dey face. We know say una no get di means to give dem borehole but make una try inform school about issues for dat side.


Toh. Me I don talk my own ooooo. And I know say I speak for my fellow students. We thank una for wetin una don do but make una do more.

Post a Comment

0 Comments