PEN PIDGIN CORNER: MAKE PIPO WEY DEY STEAL CHANGE THEIR WAYS DIS SEMESTER.

PEN PIDGIN CORNER: MAKE PIPO WEY DEY STEAL CHANGE THEIR WAYS DIS SEMESTER.


BY PROMISE EZE, 200l lEVEL EDU/ ECONS.




Na normal thing for inside UDUS to experience loss of phone, foodstuffs, clothes and handouts. For hostel, some students go wash clothe but by di time dem go wan carryam, e don disappear. Chai!!


Many pipo don suffer from di hands of our fellow students wey dey thief thief anyhow. Last semester, na for exam hall person carry di bag of my course mate for ETF III and about three android phone dey inside.


Dat same last semester, person thief the bag and phone of my neighbour when he dey read for night class inside white house.


Dat same semester again, person steal di android phone of one student wey come read for white house. When he dey sleep, di thief put hand inside him pocket, carry di phone run.


Nobody know who dey do dis kind bad thing.


Pipo wey dey thief no dey try at all. Despite di fact say school don lay down punishments for wuru wuru pipo, dem no still wan hear word.


Those way carry pipo phone and foodstuffs must know say, e no easy for everybody. If everybody start to dey grab pipo properties because life hard, how you think say dis life wan be?

As we don enter new session, those wey dey thief before must make new resolutions. Going by our respective religions, na big sin to dey carry pipo properties without permission.


Make thief thief minded pipo change their ways and no forget say God dey watch. Udus security dey watch too.

Post a Comment

0 Comments