PENPIDGINTORI:I NO KNOW WETIN DEM DEY TALK ABOUT —ASUU



By: Promise Eze



Asuu don chook mouth inside di matter of di 15.9 billion naira wey FG claim say dem don transfer into ASUU bank account. Biodun ogunyemi, di Oga pata pata of ASUU talk say: "Me I no know wetin dem dey talk about. I bin hear say FG don send us money. All dis fabu wey dey spread like perfume no be true."

"Na persin show me di news paper wey write dat tin.Honestly, di matter fear me because FG no even send me letter as regards to dat kind tori. I no see any text message sef."

"Di only tin wey I dey sure of na say Minister of labour talk say dem don do sometin. As I dey talk to you so, I no know wetin dem do"

"And also,meeting go dey on Monday. Na dat time we go sabi di tori wey dem dey yarn"

E don tey wey dis strike bin start. Asuu and FG don talk so tey di matter don weak student. Asuu go strike due to di Nyama Nyama wey dem pass through for FG hand.

Translated from  NANS news

Post a Comment

0 Comments